FWGE Day 24: My Warri Bobo by Dawn Baridor

Fear bin wan tiff my shine-shine

Sake of say Warri pikin sabi worri-worri 
but as my head take turn ehnnn 
E be lyk pesin wey shak 2 shots of shekpe 
Kia!!! My warri bobo , you too set ojare 
Con fresh lyk todai bread 
You see dat xpress nkoro for your teeth?
e dey send me on a wavy levu 
Wen you smile nko? 
E dey tortori my mind, dey make my heart do tum-tum-tum lyk Yoruba talking drum 
You nor dey yarn me fabu 
Our gist dey make me laf but sense still full am wey dey make me reason beta mata 
Switie belle dey do me 
Wen you call me swit swit names wey you dey use nak my craze 
I nor go lie you oh, i gbadu am wella 
Especially wen you call me ‘aje butter’ 
Tueh! I don tell you say na kpako I be 
But you nor gree! 
E be me say Pitakwa kpako na buttie for Warri side 
Na onli you fit scarra my dada 
Onli you fit jinja my swagga 
Onli you go be my stew zaddy 
For your mata, we die here! 
Lyk gala, I carri am for head 
Dem fit yarn their nonsense but who e epp? 
We kukuma nor send dem ni 
Becos our own na love in Tokyo 
As you no dey play me like Johnnie 
I nor go let you be my maga sef 
Aswearugad! Our love go dey kakaraka 
My swit porero! My yoriyori 
Your doings full for mouth o but make i cap gist for here.
Biography: 

Dawn Baridor is a native of Bane, Ogoni in Rivers State. She graduated from the University Of Porthacourt, where she studied Biochemistry. She loves music, nature and beauty in it’s diverse forms. She writes out her daily experiences.

JOIN US FOR MORE ON:
or
or Follow us on WhatsApp Channel

Join WhatsApp Groups

Join any of these WhatsApp Groups to receive more jobs and other opportunities

You can also Join our Telegram Group here.

> Check your mailbox or spam to confirm.

DISCLAIMER: Do not pay or release sensitive financial details to any organizer/recruiter unless futher verified from your end.

DisclaimerACEworld does not claim ownership of any image or artwork used in this publication. Any complaint as with copyright infrigment will be acted upon immediately.

Recommended For You

Got a question/Suggestion? Let's talk!